
garriTech
191 posts

garriTech
@garriTech_
Tech Evangelist | Building @ilesatech







Chai God bless my neighbor.... If you no get better neighbor like mine go get oooo... How will my good neighbor buy mifi con fix am for outside his flat because he wants everybody in the compound to have access to it since it's unlimited he purchased, I mean a compound with 6 flats ooooo, chaiiii. He don share password give everybody. As I dey type laidis na hin data I dey use oooo. I said e be like say this man no know me with my data usage, cause normally na 35k (165gb)data I dey use for 60days. As it is now, na only when I commot for house I dey use my data. E even reach sotey I go don forget say I don commot for house, go just see say messages no dey drop, I go con remember say I don commot for house. Part of the things that makes me love running home this days🤣🤣🤣🤣 just teasing. Abeg you get this kind wonderful neighbor? This one deserve my prayer because na only me know wetin e don do for me... My neighbor, God bless you and answer all your secret prayers. The network con sharp for my area❤❤❤ Airtel Nigeria Airtel Buzz Airtel Xstream Fiber













