Layaa
21K posts



"Compound drama never finish! 😤 We never even settle the first matter finish , our caretaker say him go hold meeting about the gateman, we still dey wait for the meeting. This afternoon again, the same gateman con go my neighbor house go smoke colos and start to misbehave anyhow. One neighbor rush enter the house dey fight the other neighbor: “Why you give the gateman colos again after all the drama?!” The guy swear say e no be him give am, say the gateman carry am himself. Before we know it, them dey fight dirty! During the fighting, the guy wey get Starlink for compound (wey we all dey pay subscription) just vex and change the password. Now everybody don logout, no WiFi again! Omo, I no even know wetin to do. The drama don too much! Abi make I just pack out from this compound?









