Sir White
3.8K posts

Sir White
@QuietPerspecte
Sharing Perspectives that make you pause and think

𝐈𝐒𝐀𝐈𝐀𝐇 𝟒𝟗:𝟐𝟑









Most friendships only survive because nobody’s honest with anybody. The second someone tells the truth, it falls apart.








He get one of my guys wey him name na Ejiro. We grow up for the same hood. Na very stubborn boy, but my own stubbornness na times ten for where him dey. One day, I go visit am for him house and end up spending almost 3 months there before I go back to school. Omo, that 3 months wey I stay there, no be small quarrel and fight I settle between am and him babe. Dem even get one pikin together. The quarrel later reach where the girl leave the house. After some time, she even carry the pikin come give my guy make e dey take care of am. Omo, my guy just tire for the kind woman wey born for am. One day, my guy carry him pikin go him grandma side, then come back house. I come suggest make we go carry OS. As we reach one hotel to carry OS, na there we see him baby mama standing with another guy. Immediately I see her, I point am out to my guy and say, "Bro, see your girl." Omo, my guy weak instantly. Him just dey stare. Him no fit believe say na him baby mama wey leave pikin for house come dey there. The thing pain am well well. That night, my guy no even carry any girl. Na only me carry my own. We later go one nearby hotel and book two rooms. My guy no fit sleep that night because of wetin him see. The matter really enter him body. I come tell the girl wey I carry make she help check on my guy because the guy really dey down. Omo, she no just check on am that night. She spend almost two days for my guy house. I later go back to school. Few months later, my guy call me one day and say: "Bro, I wan do introduction." Omo, I nearly drop my phone. Guess the girl wey him wan do introduction for... or make I drop Part 2?













