Whoever advised Wizkid to start dropping back-to-back songs, God go bless that person.
Few years ago, when Wizkid dey act nonchalant and no dey release music often, na like one or two songs per year him dey drop. People come dey talk anyhow—say Wizkid don finish, say him time don pass, say all sorts.
Fast forward to 2024, 2025, 2026—see as he dey drop back-to-back hits. Ehh! All those people wey dey yarn rubbish before don quiet. Dem no even see anything talk again.
I just dey wait for Wizkid to start him tour. Make I see wetin haters wan talk again 😅😂