Davidaen Initiative
1K posts

Davidaen Initiative
@davidaen_init
ISnap | IEdit | IDesign | IBrand | IRecord Brand: ConQuesT+












We Don Come Again! Dis time, our guest na @thecoachayobami, we jama am for #ABC2025 and dem di insight wey hin share with us for dis interview no be small. Watch make you follow learn: 0:04 - Who I get for here? 0:35- Wetin be your experience for the African Bitcoin Conference since you come? 0:34 - Wetin be the message you get for people wey feel say Bitcoin na scam? 3:07 - What of people wey their problem na say dem no fit wait. 5:09 - Wetin be your last advice for newbie wey never hear about Bitcoin before 5:43 - Wetin we go need expect from you for the things wey you dey do?



You sabi wetin dem dey call lindy effect? Lindy effect mean say: The longer something don survive, the longer e still fit survive. If e don last 10 years, e fit last another 10. If e don last 100 years, e fit last another 100. Now check Bitcoin: Since 2009: • Some Government don ban am • Media don argue am • Exchanges crash • Some big men don call am scam But Bitcoin still dey here. E dey stand gidibam! Every year wey Bitcoin survive, e dey add more proof say e no be experiment again e be institution. Time na the real validator and Bitcoin don dey stack time like blocks. #BitcoinPidgin #LindyEffect











