Football in Pidgin

518 posts

Football in Pidgin banner
Football in Pidgin

Football in Pidgin

@Honorablefip

Welcome to the official X page of Honorable Football in pidgin, we tok football Tori here in pidgin

Lagos, Nigeria Katılım Ocak 2026
31 Takip Edilen1.3K Takipçiler
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
Ukraine Premier League don start again o Which kind goal be this one?😂
English
0
0
2
20
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
No be John Cena and Mark Henry be this oo. No be fans be this oo. Na referee and fans be this ooo and di thing bin happen for Uganda during Synergy and UWA FC. According to reports, di whole wahala start after referee give UWA (Simba) FC penalty. As referee point hand for spot naso fans gather am oo, blow begin fly around, referee sef activate hin inner Israel Adesanya. Which day we go stop to dey attAck referees for this side?🤦🏾
Football in Pidgin tweet mediaFootball in Pidgin tweet mediaFootball in Pidgin tweet media
English
0
0
10
74
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
Tottenham don announce say dem and their coach don sit-down decide say di coach go commot for di club so that e fit get imself back. Na last month Tottenham appoint Igor Tudor as their interim coach and e never reach two months baba don commot. Igor Tudor papa bin kpai last week and according to reports di thing follow for wetin make am commot so that e fit calm down mourn hin papa wella. Igor Tudor coach 7 games for Tottenham, win 1 draw 1 come come use mistake lose 5 games.
Football in Pidgin tweet media
English
1
1
7
95
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
CAF Executive Committee members bin do meeting for Cairo,Egypt. So make I tell una some interesting things wey CAF president tok. 1) CAF president say any decision or anything wey CAS tok concerning this Morocco and Senegal matter say dem go respect am. 2) President say e dey always happy anytime people praise how referees take officiate games for 2023 AFCON wey shele for Ivory Coast(baba skip Morocco edition). 3) President say one thing with Morocco be say Morocco like to assist wella, e say Morocco na di only country wey fit offer to host any CAF tournament even if dem go make profit or not. 4) CAF president say e go visit Senegal in di next few weeks to meet with football leadership and Senegal government. E still send message to Senegalese Pepple say CAF dey with Senegal, we be one, we be one Africa. E say Senegal and Morocco get better history so we no go allow football to spoil di good relationship. Football na wetin suppose bring us together no be wetin go dey cause trouble. 5) CAF increase number of countries wey go dey play AFCON from 24 to 28 countries. 6) As for WAFCON and U-17 AFCON, na Morocco go still host am.
Football in Pidgin tweet media
English
0
1
6
59
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
One thing with us wey worwor be say if wey dey for gathering wey person mEss or tiff na we dem go first suspect. Meet innocent Benjamin Asare di Ghana National team and Heart of Oak goalkeeper wey people dey accuse of wetin e no do. Few days ago, reports bin come out say person bin dey tiff for where Ghana players camp for Austria. According to Fentuo of Joy Sports wey dey with di players for Austria, e say Ghana players bin go do training as dem come back one of di technical members come notice say person don tiff di €400 wey e keep for hin room. As e dey tok naso one player shout say dem don tiff hin watch wey e buy $20k as dem still dey investigate wetin happen. Di next day, wey dem go training come back, another player come tok say dem don tiff hin expensive watch, di same technical staff wey dem tiff hin €400 come tok say dem don tiff hin €2,000. Everybody begin wonder wetin dey sup, dem check door, no force entry that means who dey tiff am dey around and no CCTV but dem dey suspect people wey come maintain di hotel that day. As di news fly around, some Ghanaians come dey accuse innocent Benjamin maybe because e worwor abi wetin, although hin club release statement say dem don report all di pages to Ghana police.
Football in Pidgin tweet media
English
0
1
11
172
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
So UEFA tok say dem go play this season Champions league final by 6pm (Saturday 30 May, 2026) asin dem move am from 9pm to 6pm. Nothing sweet pass Champions league wey dem play for 9pm oo, I no know why dem carry am go 6pm. Well, e good sha, so that we go get time drag Arsenal if dem finish 2nd.
Football in Pidgin tweet media
English
2
1
11
145
Beyond The Match
Beyond The Match@Beyondthematchh·
Do you know it’s not a bad thing that you are a small account? I see it as a great opportunity for you to build genuine connection from scratch. The issues is a lot of small account wants ignore other small accounts because they think it’s not the right person. Don’t be ahead of the curve! Slow and steady wins the race Connect with people genuinely today
English
20
8
56
1.1K
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
Senegal AFCON parade part 3 😂😂😂
Português
1
1
11
126
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
Senegal don dey parade di AFCON trophy for Stade de France
HT
3
1
9
258
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
Oha for Oha Senegal National football team don finally do AFCON trophy parade for Stade de France despite say Morocco lawyer send warning yesterday. After di warning yesterday, president of di Moroccan lawyers club still tok say dem don send some people make dem go gather evidence( snap di organizers) for di stadium today so that dem fit use am enter court later. After all di warning, Senegal still parade their trophy, this one na di real definition of do your worst. Shebi una don buy di popcorn sha ?
English
5
1
4
229
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
One Tottenham fans group don come out tok say dem no want see Roberto De Zerbi for their club because di man bin come out defend Mason Greenwood for public. Proud Lilywhites wey be popular Tottenham LGBTQ supporter group say even if na De Zerbi go help Tottenham avoid relegation say dem no want am for their club say e better make dem go relegation than make De Zerbi come coach dem because dem dey hear rumor say Tottenham dey eye am. Roberto De Zerbi bin defend Mason Greenwood when that hin case bin dey go on for that make e no near their club. My people una say wahala be like wetin .
Football in Pidgin tweet media
English
1
1
6
343
lobistars🇳🇬
lobistars🇳🇬@john322226·
Make I answer people wey dey drag me for one of my niche contents wey dey earn me millions? Una no really well for this app Who did this rubbish go continue tomorrow
Moris Oreva@moris_oreva

@john322226 No b lie, na y u no answer me 😂

English
73
18
119
9.6K
Berneese
Berneese@theberneese·
Omo I can’t believe this
Berneese tweet media
English
1.2K
273
5.9K
611.6K
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
FT Scores: Austria 5 - 1 Ghana Just imagine, na this Ghana wey we won go Worldcup be this oo. Even their defender use hand carry ball for 18-yard box asin professional player turn goalkeeper. E better make Lesotho go represent us for Worldcup than Ghana because which kind performance be this ? Shame wear me short skirt.
Football in Pidgin tweet media
English
3
2
32
468
Football in Pidgin
Football in Pidgin@Honorablefip·
This AFCON matter don dey enter another thing oo😂 • Senegalese football federation bin tok say dem go parade their AFCON trophy for Stade de France, Paris tomorrow despite say CAF tell dem make dem return di trophy. • Now oga Mourad Elajouti wey be di president of di Moroccan Lawyers club don come out tok say dem hear say Senegal won go parade AFCON trophy for Stade de France tomorrow. So dem don send formal legal notices( letter) give Stade de France and GL Events say anything wey make dem allow Senegal parade that AFCON for Stade de France tomorrow say dem go carry dem go court because na illegal thing dem won do. Dem say make those people collect di trophy from Senegal hand or make dem no allow Senegal parade because if dem allow am say dem go pay for damages because CAF don already award di trophy give Morocco already. My people una say wahala be like wetin ?😂
Football in Pidgin tweet media
English
3
1
14
312